OH PARACETAMOL!!! - An enlightenment post by Pharm. Tech Temiyemi Pharm Tech: Goodmorning Ma (in my most polite tone). Patient : Good morning ooo. Abeg una get paracetamol cd? Pharm Tech: (switching to pidgin): Yes but who wan take am? Patient (hesitates, then finally speaks): na my pikin. Pharm Tech: How many years way him dey? Patient : 2yrs old. Pharm Tech: How him body dey do am? Patient : nothing dey do am, I just wan keep am incase of incasity. Pharm Tech: OK, but madam, e for beta say u give am paracetamol syrup instead of the tablet becau...... Patient (cuts in): Nooo madam, tablet dey work well well pass dat water mericine. Once I sama my pikin I tablet, him dey get himself fast fast. Pharm Tech : madam, One tablet dey too much for your pikin and e dey harmful to him hea...... Patient (cuts in again; this tym around with a frown): Madam abeg give me the drug make I dey go; I no get time for all this una big big talk. She collects her drug and walks away...